Mr Chairman,
Accurate time keeper,
Impartial panel of judges,
My able Friends,
Fellow Co debaters
All protocols duly observed.
My name is my name, and I am here to propose the notion
that states..
( ‘Nobody senior another person for this life, na turn by turn’, )
with my following reasons.
1. Dem first born you no mean say na you go first die. Even
Bible support am.
2. If you first me touch ceiling because you tall, I go first you
to pick stone for ground because i near ground pass u
3. You fit first me enter SS1 and I fit first you enter university.
4. My jeep fit stop for road while your Beetle fit carry you
reach house.
5. Girl wey marry last year fit born pikin before woman wey
marry 10 years ago.
6. Small boy wey just finish school fit begin work before
chairman wey do NYSC 2015
7. If aeroplane engine knock, both person wey dey first class
and the one for economy, na the same Jesus dem go call.
8. Na Oga de pay driver, but AC de first blow driver before e
reach oga for back.
9. Person wey de healthy fit die before person wey de sick.
10. You de stay upstairs no mean say you near God pass.
11. Stone de scatter water, and water de pieces stone.
12. When you see me na when I see you.
13. Babe if you senior a guy no mean say u no fit date am, age
na number.
14. Mr time keeper, as you want to ring that bell, may your
time in this world not be over.
15.you go church everyday no mean say you better pass
another person,calm down and do what is right cus even
Satan dey go church.
I hope with these few points of mine, I have been able to
convince and not confuse you that ( ‘no body senior another
person for this life. Life na turn by turn.)
Tags:
Joke